NEW OGA WAHALA.
One of the reasons why I like neighbourhood salons is because I get to hear all the neighbourhood juicy gossips. Lol! Neighbourhood gossip is good for my health and yours oh! Smh! For me.
So I went to retouch my hair last night and was disappointed to find the hairdresser alone. I said to myself no gossip today, I jejely sat down and the hairdresser started applying relaxer to my hair. I sat for a while then she washed the hair, as she was washing the hair two young girls maybe in their early twenties entered the salon and started the gisting. I was so interested in their gist that for someone that has not used rollers for so many years, I asked the hairdresser to roll my hair so I'll finish the gist. Lmao!
Hear the complete gist.
Girl one ::: na wah oh! I no know say you been dey
Sell cloth i for dey come buy from you.
Girl two ::: no be small thing, I been dey sell cloth
Until one girl like that come bite me for
hand Naim make me stop.
Girl one ::: ah! Person bite you? Your fellow girl
Bite you for hand you come stop business
Why you no bite her back, why you
no give her correct wound wey she no
go forget. Wetin happen?
Girl two ::: my dear, I been dey sell okrika shifon
tops been dey go mile one park dey
Buy for bail come sell. The girl come
Carry her boyfriend come buy tops
From me o. She buy something of
27k the guy come pay 10k say him
balance me by month end. Before
month end the guy come meet me
Say him no dey pay the balance
again because the girl don get new
Oga wey she dey sleep with, him
say him with the girl no dey again
make I come make him carry me
go meet the girl and her new oga
make the new oga pay me
Naim I leave akamu wey I dey drink
follow the guy go there. When
we reach there the guy leave
wetin we go do begin beg the
girl where the new oga dey.
Come tell the girl say even though
she don get new oga say na him
still love her pass, the girl no gree
because her new oga dey there
the guy come vex say him no go
pay the balance again come tell
the new oga to pay, that one
no gree the girl wan run I come
hold her for hand she come bite me run
na police settle the matter.
I went home laughing really hard.
lol @ new oga
ReplyDeleteSo that makes you a neighbourhood gossip abi? #Flees
ReplyDeleteOkoonkos
ReplyDelete